Friday, March 23, 2012

E Don Happen, Na Wetin I go Talk?

Posted in:
Do you remember the story of a househelp, her madam's white trousers, and a naked oga in the master bathroom? This is the sequel...


As I turn face madam, na plenty tings jus enter my head, wetin I wan tell madam? Which kain lie I go take lie wey my punishment go reduce? As I don dey used to this place, e no go too sweet to return go back to the place wey my papa and mama dey stay. I no talk say I no like my papa and mama o, before una turn to dey curse me but I don big pass the place wey dem dey stay and no be mouth. A girl suppose aim for the skies na, abi no be so? As madam wan open mouth shout again na im I jus fall for ground dey roll.