Dat morrin as I wan baff na so I dey put ear for dis babe music, Omawunmi, dat song wey she sing say, ‘If you ask me, na who I go ask?’ My madam don comot tey tey and I know say before she go come back e go still tey, so I say before I baff make I carry my body go upstairs for her and oga room. E get one fine white trouser wey she buy and I be one go taste am because I hear say person yansh dey come out well well for white trouser especially if you no wear pant or you wear g-string. Before I go continue my tori make I talk about my madam and oga dem.
My Madam: She no too good, she no too bad. Sometimes when I go market come back late, she no go even send me. She go just talk say, “Ehen, I know you went to see your boyfriend. Thank God you didn’t stay too long. Now hurry into the kitchen, my baby would soon be back.”
And sometimes when I wash clothes and the ting still get small stain, she go talk say, “You are too dirty Mary, sometimes I wonder if your undies are even clean”; and the annoying ting be say na infront of oga she go shout the whole ting so tey my oga come dey look me one kain.